facebook
linkedin
twitter
youtube
google_plus
email
  • Home
  • Our Ministry
    • Our Goal
    • Our Aims and Objectives
    • Basis of Our Faith
    • Our Beliefs (Articles of Faith)
    • Vision Statement
    • Mission Statement
    • Salvation
  • Members
  • Blog
  • Donation
  • Contact Us
  • Webmail

Blog Post

0

Churches resume in Lagos State

16 Sep 2020
Ogugua
churches, religion
Church resumption in Lagos State latest updateSome big churches for Nigeria wey get dia headquarters for Lagos State South West Nigeria don announce say dem no go resume church services for 9 August afta goment lift coronavirus lockdown order on worship centres.

Nigeria goment bin suspend religious gatherings for kontri since March to curb di spread of di virus.

Di Presidential Task Force on Covid-19 bin down allow di reopening of churches and mosques in di kontri for June but di Lagos State goment no gree allow worship centres for di state to reopen sake of di increase in coronavirus cases.

Dem later give go ahead for religious gathering to start on 7 August.

But some churches for di state don come out to say dem neva ready to reopen.

Di churches get different reasons for dia decisions, some say na to prepare di place for reopening wey go meet di safety protocols of di federal goment, others say dem dey wait to hear from God before dem reopen.

  • Key rules and guidelines places of worship and social centres for Lagos must follow as dem reopen
  • Lagos goment don give go ahead for places of worship to reopen on 7 August

See di list of some churches wey no go open for 9 August:

MOUNTAIN OF FIRE AND MIRACLE MINISTRIES

Di leadership of Mountain and Fire and Miracle Ministries MFM tok say pipo no go gada together for service for all dia church regions, branches or zones wey dey Lagos and Ogun states until 13 September 2020 as dem wan put in place preventive measures against coronavirus and follow all di safety protocols wey federal goment, state goment and NCDC put for ground.

MFM on Church resumption in Lagos State

WIA DIS FOTO COME FROM,DANIEL OLUKOYA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto,

Daniel Olukoya na di Senior Pastor of Mountain of Fire And Miracle Ministries

About the Author

Social Share

  • google-share

Leave a Reply Cancel reply

*
*

Copyright © 2025 Star of David’s Evangelical Ministry All Rights Reserved. Powered by Emex Systems